Episode 19
Me and Flex entered inside our new house.
Me: that girl is really friendly o.
Flex: yes she is.
Me: but me self won come f–k up.
Flex: no be say you self won come f–k up. You don already f–k up.
Me: how, you know see say she don already forgive me.
Flex: yes o, you are right. She don already forgive you.
Me: so na how he go be?
Flex: I no understand you again o.
Me: about the girl jummybabe. He be like say I like her o.
Flex: you dey craze, thunder fire you.
Me: na wetin I do again na.
Flex: you dey stupid for asking that question.
Me: see, you better stop to dey insult me before I tear you slap o.
Flex: try am if you fit. Girl wey go be my girlfriend na im you won go chike?
Me: girlfriend? How?
Flex: you no know say na her I book as my girlfriend?
Me: hahahahaha. You don book girl wey never agree to date you.
Flex: ah, na now I know say you no get eye.
Me: why you say so?
Flex: you know see say she don already fall in love with me?
Me: tarh, make I shi.t egg.
Flex: and u go shi.t the egg.
Me: na me she like no be you.
Flex: you wey dey fear her. Lol, abeg go sitdown for one place jare.
Me: ok, make we bet first to get her.
Flex: no problem, make we do.
NEXT DAY…
we were in a meeting, tenants and landlord meeting.
Oga val: my tenants, I greet una o.
All tenants: landlord we dey hail oo.
Oga Val: una know the reason why I call this meeting?
Tenants: no sir, please tell us abeg.
Oga Val: we don get new tenants for here, so we can go kindly introduce ourselves to them while them too go introduce themselves to us.
Me: My name na Idris.
Flex: my name na Donflex but you can call me Flex.
Oga Val: na me be the landlord val.
Man 1: welcome my name na froshberry.
Man 2: welcome I be Konami.
Man 3: una welcome I be frankay
Man 4: welcome I be Talent scout.
Me and Donflex: Hahhahahahah, how manage your talent dey scout?
All: hahahaha, nonsense guys.
Leave a Reply