Episode 21

continues from the last episode

we entered inside our room confused.

Me: Donflex I don confuse o.

Donflex: I swear me too don confuse.

Me: wetin confuse you?

Donflex: the issue of girls we have here.

Me: yes oo, that’s the problem o. We have victoriouschild, denncygirl, soma and jummybabe, which one we go choose?

Donflex: erm, lemme see….

Donflex: ok, see the way me and go do am, we go share them two two.

Me: ok, me go carry jummybabe and erm, erm, denncygirl. Then you go take Soma and victoriouschild.

Donflex: thunder wey go fire you dey do press up, me go take jummybabe with one person while you go take the remaining too.

Me: why can’t you just leave jummybabe for me.

Donflex: and what is the main reason why..why…why……why…!!!

Me: you no go school abeg, speak pidgin English before you bite your tongue.

Donflex: ok thank you, wetin be the main reason why you too dey follow her.

Me: ok, make we do first to get her. You agree?

Donflex: ok no prob. You know say she no even dey during the time of the meeting ba?

Me: yes oo na true, make we go check on her sharply sharply.

I said and we all ran out of our apartment in search of jummybabe, each man with one thought in his mind, “The fastest way of toasting her”


we come outside and I see talent scout dey gim, the kind of gim wey me no go fit carry for the next seventy-three years na him this young boy dey gim like water, na then I come start to regret why I curse am in the first place.

Me: brother good morning!
I greeted him while he turned, kept the weight he was carrying and smiled. He took a towel by his side and cleaned up his sweaty body.

Then he folded his fist and started to approach me.

Me: brother I dey greet oo.

Talent scout: you dey greet who?

Me: brother na you I dey greet.

Talent scout: ok, that one concern you because wether you greet me or not, he no go prevent me from dislocating your bones.

Me: iyeee, brother abeg no be so we dey do things naw.

Talent scout: but no be you dey curse me that time?

Me: I dey craze, wait, you don see me say I dey craze, I dey mad to curse you.

Flex: hahahhaha, brother abeg pity am.


You May Also Like 🔥


Be the first to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published.


*