Just Wedded

Episode 7

(Doris family House, she bangs at the gate as kasali goes to open the gate)

Kasali: I de come o! Who be that! (He shouts as he rushes to the gate)
Doris: Baba k, how are you? Long time!
Kasali: Ha madam! Welcome o iyawo tuntun (new Bride) welcome ma! How Oga nah?
Doris: Oga de o! How your family nah?

Kasali: We thank God o! Kai! Aunty marriage good o! Just one month see as you don fresh finish, you be like Tomato from Jos! Chai Oga Charley na correct man o! See as he don polish you so tay you de shine like,like, em, em (Interruption)
Doris: Baba k so you mean say I no de shine before I go husband house? (Laughing)
Kasali: Haba Madam but you know say shine pass shine nah! This one wey I dey see for your body so na original Kiwi Shine! No be any how polishing at all, this na Kiwi!

Doris: (Burst out laughing as she runs towards the House) Ha Baba k! You will not kill me O! Jeez!

This is why I love home, hmmm home sweet home!

Kasali: (Shouts after her) we don de wait for you since morning! In fact big madam don prepare special Chop de wait una. Na me go buy the things them from market…… (Continues till fade

You May Also Like 🔥


Be the first to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published.


*