Read Story: SEASON 1 EPISODE 6
At first I think say na joke until the hand started massaging my bum
I quickly stood up, abi I dey hallucinate nii?? I thought when I no see the hand again
I lie down again and changed direction when the hand came again
Voice: Alaye calm down naw, na cleansing we wan do for una
Me: Cleansing for wetin, I dey do deliverance??
Voice: Shut up! una too dey talk too much
Like play, like play four hands started to pin me to the floor
Me: help! help me oo
Oga officers, ancestor officers, my generation Officers!!
Two officers came running like Christmas fowl wey they wan kill.
Officer 1:Why una dey shout like pikin wey dem just born wey tell God say him wan go America but meet himself for 9ja
Officer 2: Bia, which officer na your generation officer??, criminal no dey my generation
Me: Abeg make una comot me for here
Officer 2: Comot you for here??
Officer 1: Who you be??
Officer 2: President pikin??
Officer 1: Talking to the guys** wetin una do am??
Guy 2: We wan do cleansing for am, as our new paddy
Officer 1: Cleansing for wetin??
Officer 2: Eeeeeehhh Pastor criminal when una start evangelism ehn?
Me: Abeg ago pay una comot me for here fess.
Officer 2: How person wey be say na only 200naira him get for pocket fit pay us?
Me: Officer forget that one comot me for here naw
They sha later took me out, this night was a very cold night so almost all the officers are the sweaters, the station seff is almost deserted, those Officers that came to arrest me were not there again I think they are the afternoon shift.
I sit down no reach two minutes when they started asking for money
Me: Oga make una calm down naw, I go give una tommorow.
Officer: Abi this one dey craze? who you dey scope? See ehn, iffu no gimme the money now now I go throw you for inside that cell again.
Me: Haha make…
Then we started hearing noise people were throwing words at each other.
The officer wey dey my neck don dey smile like Easter snail.
Officer: Chaii market don set for this night oo.
They started making noise those officers nodey help matter at all.
They suppose to quench fire dey dey add petrol.
They seem to have forgotten me.
I sneaked comot for their midst and started running when one of the station guard saw me dem no waste time at all dem pursue me oo.
Las Las them catch me, but the cell wey dem put me this time around worrrrse ah! E worse.
I was welcomed by a resounding slap.
Guy: As una don come laidis go fan our oga until him sleep
Me:Why ago fan person when I suppose sleep??
To cut the long story short, I fanned the unwanted pig wey dem call boss oo.
One officer came to drag me out and I was told Queen is dead!
Me: Queen is gini??
I screamed oo, baba God shey na laidis I’ll go prison coz of 7k ehn??
Leave a Reply