Read Story: SEASON 1 EPISODE 7
So me nd karasco plan to revenge on ma grappy
we do set trap com use grass cover
as grappy dey pass him no no say trap dey there.as im com match am com see d scream wey grappy shout
grappy:(shout)yeeeeee moku o my leg
me nd karasco com do thumb up.we com go our different auz
wen i reach i dey happy
mrdan:him go know say i senior ram
ma grammy com tap me i dey shock
grammy:mrdan watin u dey tink
mrdan:oh notin
grammy:where u run go since
mrdan:i go chemist i no feel fine
grammy:well ur grappy don go farm
as we were still talk we saw some people carry grappy on their shoulder
grammy:(scare)abeg watin happen to ma husband o
man1:he match trap ni
grammy:ahhhh
man2:we help u carry am come so we don dey go
we help grappy to parlour
mrdan:grappy make i go bring hot water help u massage am
i left to put water on fire wit a wicked smile
mrdan:if to say u limme jeje dis one for no happen
i place d water on fire i won make e hot well b4 i go carry d basin 4 backyard
grappy rant nd shout na im feel d auz
Leave a Reply