Read Story: SEASON 1 EPISODE 18
I still dey think wen i hear karasco talk say make dem give am simnoff and pepper soup
mrdan:i tink it high time i disgrace dis guy me wey get money gan i no ordaer too muchehn karasco i won go pee
karasco:ohk no tey o
i went to d barman
mrdan:how much be my money
barman:ur own na #2000 bt ur friend own na #4000
i gave d barman #6000 for me and half for karasco so him punishment no go too much,i sneak out of d bar
i went home to siddan for under d mango tree dey reason
mrdan:abi make i tell sandra make she send me some moneys to open a car wash along d express
i pick ma fone call her num she pick am,i tell her all ma plans at 1st she no won gree bt after much convincement she later bt i should plan how much i go need
i jump tell grappy say i dey come
i went to d express to look for where suitable,i later found one and i make enquires about who get d land dem tell me him auz
i went to his auz tenk god say i met am for auz
we talk sotey b4 we later agree on #250000.i later went home to do ma budget
Leave a Reply