Read Story: SEASON 1 EPISODE 10
Immediatly i get down from d bus at begger i ask from d agbero d moto wey dey go cms he show me one nd then left
mrdan:abeg how much b cms
conductor:#200 enta with ur change o
i enta 4 front na only one person remain d conductor still dey shout cms cms
one man dey drag him load com my side com dey hala me
man:pls mister dat my seat
mrdan:sho i meet u here ni
d man open d door com drag me down we com begin dey fight
naso all those agbero come dey style style search my pocket dey do like say dem won seperate u i laff 4 mind
afta dem don seperate u those agbero angrily walk away i sat 4 front nd d man sat for back as our bus won comeout 4 d garage one of those agbero came with one iron wey suku suku dey dey ask 4 money
agbero:oga owo ticket e da
driver:ma wa fun e tin ba de
agbero:i no won hear dat kin tin na nana i want am if i leave u now u go dey dodge me
afta dragging nd d shout from all d passenger d driver said make d conductor give d agbero #200 afta dat d agbero carry iron naso we begin d journey
Leave a Reply