Read Story: SEASON 1 EPISODE 11
We neva reach far place b4 one man dey preach
preacher:hell fire is real repent orelse na hell u go land u dat fornicator,armed robber nd sinner na hell fire u dey go i rebuke u
d man dey shout for my hear i shun am
mrdan:oga na only hell fire u dey preach u don visit there b4 ni
d preacher look me with one kin eye b4 im continue with im preaching.d conductor com dey collect money
conductor:yes money from front
i gave him #200.he continue dey collect him money bt without insult to those without change.he com reach d preacher turn
conductor:oga wey my money
preacher:pls son of god i beg u i no see my money
conductor:ehnehn na now u know say i b son of god bt u been dey preach hell
naso everybody burst 4 laff
driver:conductor who no won pay ur money
conductor:na dis preacher o
driver:ehs abi kofe da fun yin ni u dey garage wen those small boiz dey abuse me
d driver park com ask d man make him come.d man just dey beg until some pay 4 ram
throughout d journey d preacher no do fem
there was peace in d bus again
Leave a Reply