Read Story: SEASON 1 EPISODE 29
You know I am just recovering from
heartbreak and would not want to commit
myself immediately.
Please forgive me. It won’t repeat itself. I
love you more than you love me.”
Perpetual don come again!!!
I dropped the phone. I was happy inside o
but men, I was also confused. So this babe
been don like me na im she wan turn me to
her money bag eh. My finger just dey scratch
me make I call her but my mind dey say
make I relax. If I call am, e go show say I dey
desperate for a come-back. Come-back to
wetin self? Wasting my money without
tasting shi-shi from her honey pot. Some
girls just dey too
wicked walai. After guy don spend for you
finish, you go come break up with am. Once
them realize say them really gain from you
and no maga dey forthcoming, them go use
sweet talk take bath your ear. If you mumu,
you go fall the second time.
“Na wetin this babe want now? After she don
form finish she wan come back. Maybe I go
draw her oil
this time”
Na so I dey carry talk to myself when
something dey bother me. Una no fit blame
me sha, every man dey always determine to
succeed for where him been fail before.
“brrr brrr”
My phone begin ring. I look the call, na so I
ignore am. The phone come ring 4 more
times. All na Perpetual dey on the line. Kai, I
just dey gyrate say na my time to do yanga
be that. I no call am till when I close from
office. Na that time I say make I call her so
that I go gist the short journey from my office
down to bridge or massalaci junction wey I
go see car enter.
“The number you are calling is not reachable.
Please try again later”
Thunder go fire MTN or the mumu network
wey no good. Useless people wey no dey like
their customer enjoy better thing. Na so I say
make I begin vex when my phone start to dey
ring again.
“brrrr brrrr”
I no form big boy o. After all, na she wan
apologize no be me. Na so I pick the call
come keep quiet for like 5 seconds.
“Hello, are you there?”
Kai, I miss that voice. Na so I swallow spit
compose myself. I no wan talk like say I dey
excited.
Lovely comedy