Read Story: SEASON 1 EPISODE 30
My phone begin ring. I look the call, na so I
ignore am. The phone come ring 4 more
times. All na Perpetual dey on the line. Kai, I
just dey gyrate say na my time to do yanga
be that. I no call am till when I close from
office. Na that time I say make I call her so
that I go gist the short journey from my office
down to bridge or massalaci junction wey I
go see car enter.
“The number you are calling is not reachable.
Please try again later”
Thunder go fire MTN or the mumu network
wey no good. Useless people wey no dey like
their customer enjoy better thing. Na so I say
make I begin vex when my phone start to dey
ring again.
“brrrr brrrr”
I no form big boy o. After all, na she wan
apologize no be me. Na so I pick the call
come keep quiet for like 5 seconds.
“Hello, are you there?”
Kai, I miss that voice. Na so I swallow spit
compose myself. I no wan talk like say I dey
excited.
Everything na step by step.
“Yes, I am”
I answered, my voice come even surprise me.
The bass just come out, men, I come dey trip
for myself.
See bass abeg.
“Did you see my message?”
See question. I blind?
“Nah, did you send any message?”
I want make she use her mouth take talk
wetin dey the message. Una no fit blame me
na, once the wind change, na to mess follow
the direction. Na who dey road go hear the
smell.
“Ok, maybe network is holding the message
even though it showed ‘delivered’ on my
phone. Did you see my missed calls?”
Them no dey lie for this kind question. Mind
you, no be lie I dey lie, I just dey play
matured game.
“I did but I was busy.”
Na so her voice change…
“Busy doing what eh!”
O boy, the babe never change o.
“If you are going to talk to me in that
manner, I will drop this call”
Na so I threaten am. By that time I don dey
wait for car make e come.
“I am sorry. I love you and I want to be with
you.”
Walahi, this kind question no be me dey
answer am, na my diicck dey always do the
talking.
The preek just charge slightly as my mind just imagine how her body go look like
if she no wear cloth.
“hmmmm…”
Na wetin comot from my mouth but for my
mind na
“I FEEL GOODDDD… TA RA RA RA RA RA”.
“Is that all you will say?”
By that time car don come and I don jump
enter inside after elbowing one guy comot
from road. The guy self just dey outside dey
abuse me. For where, I send am, me don
enter car, na wetin important be that
“Hey see, we will talk later. I just entered into
a car.” (this line famous ma)
Na so I drop call before she fit protest.
Minutes later….
“I will be waiting for you in Oceanic Bakery”
Sweettttttt!!!!!!!
Lovely comedy